Must Read and Advise.

Me i no fit tell wetin dey happen for school anymore. They have turned our Master/miss Go contest to...  Emmm....  Bina foundation contest or something.  It is now we have seen the strangest of contestants ranging for 'Shorties' to 'Afi' to 'Awala' and the rest. 

Ok i go their rehearsal you know as usual to get turned up by beauty but as i reach there,  first first,  i jam Albino.  I come dey think say maybe she been no see well where she come shaa till she walk first one walk second one na em i know say 'night don reach and aunty love don close'.

As e dey go,  i come see another one wey dey like all these girls wey we see for 9jabet shops.  Plus say she dey like say she never chop this semester.  I come dey wonder who give am money buy form so i reason say maybe em chop bet shaa.  You know say as e be,  i no go call her name o but she gatz know herself.

As the next girl dey comot,  i come dey find the girl as where i dey dey only see from up,  me as i short reach,  i climb o come see something wey only dey ad tall as those plants for convocation arena.  I come think say na all those women wey dey sweep pikin.  Like joke,  the girl blow me kiss o,  well the kiss hit me for leg shaa as i tall reach.

Omo eh,  as i come dey anticipate dem boys,  first i come see one boy wey fine o,  i happy small but wen the boy begin waka,  e come dey like say na audition for civil war. Joy no dey the boy mind.  E be like em mama force am enter the pageantry. Me i call that one Captain America.

Awala,  wetin happen?  Wetin give awala mind enter there? Awala with em red awala slides and em 'almost fetty wap eye' waka comot o.  Me could not take it no more.  I ran jare.

Friends biko advise your friends.  If i bin no get friends,  i for no carry my small self enter there? Enjoy your weekend.